Friday, 24 August 2012

Na wha for nupeng o !

My contri pupil, I thank god say government and union way dem de call nupeng don say no more strike for tu weeks,so dat dem wit government fit sitdown and Tori how dem go pay de pupil way trutru bring oyel from oversea wen government never pay, de trut be say some want to use magomago take collect awuf money, but goverment say dem must to make sure say na onli de pipol way show paper say dem bring oyel naim dem go pay,but de tin way pinch awa bodi be say, wetin concine nupeng wit say dem nor pay oyel marketers? Abi dem sabi wetin we nor sabi? Hen, if I be president, I go cach dem and put hot pepe for dem eye, bicos dem surfer us wel wel oo,tel mi, why dem go take panadol for anoda pecine headache ah de Tori taya us o.
until una read me again make una stay wel o.

No comments:

Post a Comment